"THINGS I AM THANKFUL FOR - 1 I no be American. I no get Green Card. I no dey stay for Yankee. I no even get visa to visit sef. The last time wey I reach America na June, 1994. Na NDIC carry me go. Dem send me make I follow CBN pipo go do routine examination of United Bank for Africa for New York and Cayman Island. Na double entry visa we collect. We been think say we go go Cayman Island true true. Na when we reach New York office of UBA dem tell us say di branch we dey for Cayman Island na only paper dem get am. Na "Offshore" branch! Till today, I no know Cayman Island!! :-( But I know Dallas, Houston, Washington DC, and New York. OK, I don first talk New York, abi? Yes, you are correct. By di way, come oh, so you dey read dis yarn true true? LOL! You no get work!! You like my tori no bi small. LOL!! Na 1993 I go those places wey I follow my two ogas for NDIC go understudy the Bank Failure Resolution Department of the FDIC for America. Immigration been no wan give me passport dat time. But na God win. Anyway, I come collect American visa again for 2000. Abi na 2001? My wife, Awesiri, sef get am. We been wan go jolly for God's Own Country. We no come get money to buy tickets! No laugh na. Di time you manage travel go ya sef, no be borrow you go borrow di money? And how many years you take before you fit pay back? If no be say you get sister for America wey squat you and dey give you food chop, how you for do? Anyway, you sef be been-to na. Oya, clap for ya sef. But I dey travel oh! Since dat 2000 (abi na 2001?), I don go London plenty times (thanks to my main guy: Uncle Senior Pastor Prince, Ademola Sobogun, whom God dey use butter my bread. I don also reach Kiev, Istanbul, Frankfurt, Amsterdam, Johannesburg, Cape Town, Accra (Accra na "abroad" na), Tema, Akosombo, Lome (Lome sef na "abroad"), Dakar, Yaonde, Cairo, Nairobi, Bujumbura (go find ya map look am na; why you open mouth, open eye like dat make efri bodi know say you no sabi Bujumbura?). I don also go Lusaka, Kigali, Kinshasa, Goma (look map again). Dem no gree give me visa to Botswana, I for don know Gaborone. Fear dey catch dem say Naija pipo wan start bank for their land. Meanwhile, di agent we suppose hep get me and Uloyok Job di visa in 2007 collect $600 for awa hand come yab! Anyway, na Jerusalem, Paris, Rome, Rabat, Tunis, Abidjan, Los Angeles, Atlanta, Tokyo, Hong Kong, New Delhi and Beijing ma dem I wan go now.....If Jesus tarries and money dey. GOD GO DO AM again. Lord, these are just some of the things I am thankful for. Praise God! EMHIN REBHE DI FURE BHE GBE MHEN. :-D"